Aproko Vanguard

Aproko Vanguard Bringing fresh gist and Aproko to you from within and outside 9ja. Photography and Media Productions at Affordable prices

APROKO!!!Area, matter dey ground.According to report when reach our hand, e veg one Emmanuel Lorliam when be soldier, ac...
12/10/2022

APROKO!!!
Area, matter dey ground.
According to report when reach our hand, e veg one Emmanuel Lorliam when be soldier, according to the report, them catch the guy when when he dey try dodge carry bullets and things go sell give Nigeria enemies which is the Boko Haram people.
According to the Aproko, the guy done dey do the thing Tay, but nobody put eye, but recently as the guy dey do, he friends and fellow army come dey suspect him and notice say the guy way no pure again. Na Dem lay ambush and catch him red handed.
Right now, them done arrest him and take off the Nigeria army uniform from his body.

More Aproko dey come.
No forget to like and Follow this page for more current aproko.

NEWS!!!My country people.I done bring one news come give una, but this one na from Abuja, from the A*o Villa where our p...
11/10/2022

NEWS!!!
My country people.
I done bring one news come give una, but this one na from Abuja, from the A*o Villa where our presido dey stay.
Them say them go spend about #1.6bn (One million, six hundred million naira) for internet and stationaries like books and other things to do the daily work of the office.
According to report when reach us be say, the money na Telephone charges water and other things to make sure say things go well for the country.
Na for the 2023 budget when the presido submit na Dem take bring this information come outside.

We dey come, make we go make more aproko come give una.

No forget to like and Follow this page for more current aproko.

APROKO!!!Area gist dey o.Popular musician Harrysong done enter matter. One Sosobrekon when be music manager and director...
11/10/2022

APROKO!!!
Area gist dey o.
Popular musician Harrysong done enter matter. One Sosobrekon when be music manager and director done go report to police office and them done arrest Harrysong as he just land for Nija from he travel when he no go for Abroad.
The matter when be happen before be say, Harrysong first drop on podcast say the guy which is Sosobrekon been send boys come kpuf am.
And the Sosobrekon no take the thing as joke, he take the matter very serious, so he go make report, na so police carry Harrysong.
More details go come.

No forget to like and Follow this page for more gist.

APROKO!!!Area I greet una specially.The matter when we gather about Davido and his lover, Chioma be say The 30BG oga him...
11/10/2022

APROKO!!!
Area I greet una specially.
The matter when we gather about Davido and his lover, Chioma be say The 30BG oga himself want buy that Motor when them dey call G-WAGON give the Babe. Unto say as their love done dey strong and the assurance of 2023 done dey strong pass wetin Dem use Dangote cement mix, the two love birds done dey use love pollute the area.
But another story dey come say e be like say the babe done get another belle but them never confirm the gist.

For more story and Aproko, no forget to like and Follow this page.

SHARP NEWS!!!ASUU body say very soon the University strike when them start February this year, say the strike go soon en...
10/10/2022

SHARP NEWS!!!
ASUU body say very soon the University strike when them start February this year, say the strike go soon end and students go return back to school.

APROKOAs the 2023 Nigeria general election dey draw near us, and so many people dey prepare for the election, the PDP Wh...
10/10/2022

APROKO
As the 2023 Nigeria general election dey draw near us, and so many people dey prepare for the election, the PDP Which is People Democratic Party done start their campaign today for Akwa Ibom State. People when attend the rally campaign plenty. And as normally, the person when dey contest for the president seat, Atiku and his Vice Okowa dey there present and promise many goods things when them go do for office if the country people vote for them and remove APC from power next year.

This na the story for now.
Follow and like our page for more.

NEWS!!!According to wetin we hear now, Nigeria navy done intercept vessel (big boat) when corrupt people take dey thief ...
10/10/2022

NEWS!!!
According to wetin we hear now, Nigeria navy done intercept vessel (big boat) when corrupt people take dey thief Nigeria crude oil. The security agents catch them for river side and burn the ship immediately.

APROKO!!!The Aproko when dey around now be say another good Samaritan done dash little girl Success Chioma and her mothe...
10/10/2022

APROKO!!!
The Aproko when dey around now be say another good Samaritan done dash little girl Success Chioma and her mother half a million naira. The little girl when be follow her mother go Obidient rally done really attract success come their home after some people first dash them money last week and give the girl Scholarship to university, today again another good person done dash them 500,000 naira cash.

APROKO.The Aproko when reach out end this afternoon na be this.This girl done share story of how she and this guy for th...
10/10/2022

APROKO.
The Aproko when reach out end this afternoon na be this.
This girl done share story of how she and this guy for the picture take dey. According to her also, she dey motivate people when dey this world say no matter the situation when you see yourself, make you no give up. And no matter wetin happen, try dey close to somebody because true friends still dey and na them dey make things easy and better for us by giving us the reason to live.

After the confirmation when Davido talk say he go marry his lover Chioma me year, the love birds done drop another beaut...
10/10/2022

After the confirmation when Davido talk say he go marry his lover Chioma me year, the love birds done drop another beautiful pictures.
This love na the real assurance when Davido sing.

follow us for more gist.
.

We dey bring you fresh gist and Aproko from all over the Nation and Abroad.We dey cover both News, Sports, Politics and ...
10/10/2022

We dey bring you fresh gist and Aproko from all over the Nation and Abroad.
We dey cover both News, Sports, Politics and Different matter when dey happen for our community both far and near in Nigeria Pidgin.
Keep the notification on and share to your friends.
.

Address

Lagos

Telephone

7062853698

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Aproko Vanguard posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Share